PIDGIN ENGLISH; Wetin dey?

My people,

How go dey go? Hope say body tanda gidigba.

                                                                               

I talk say make I hail una small. Una do well for me plenty plenty; and because of this, Baba wey dey for heaven go do for una. Una no go waka miss step; who talk say you no go light stove, no go see kerosene buy for im town (according to Gordon's). Na so so nyafu nyafu things go take dey reach ur hand; you go see your pikin pikin.
Your pikin go bury you, and your pale and male go dey take you make mouth for area. Make church hala Amin..

Okay, I don talk am before say plenty things go take style arrange for this una page. We no dey do aproko sha; but we dey gistt as brother and sister wey we be; all na hustle, make pepper for rest na; girls (no be only boys) gasto hustle na. Every week, we and una go gather for this koro like 3times, knack our tory. No be only dat one, we go dey bring una tory of person wey either don hold im side; or im dey waka dey go hold him side. So dat all of us go dey learn how dis life go make sense for we.

Na so I take end d tory for here oh. Make una no worry, all of us dey move go permanent site just now just now.

AREA; 3 gbosa for una!!!!!

2 comments

Gbosaa!

Gbosa for you jor. You do river, e pass well sef!